Monday 11 May 2015

Jokes Of The Day

1.  Chicken wey run way from Borno go Ibadan go still end
     up inside pot of soup
     loose translation: You Can't Run Away From Your Destiny
 
2.  Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap
      loose translation: Keep calm! Nothing last forever
 
3.  Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef
      loose translation: Just be patient. Let the game come to you. Don't rush!
     
4.  Akara and moi moi get the same parent na wetin dey pass through make dem different
      loose translation: How you start doesn't matter, what matters is how you finish.
 
5.   If life dey show you pepper,my guy make pepper soup from am      loose translation: Make something good out of a bad experience 
 Read more after cut........

6.   I get  am before no be property                            
       loose translation: stop living in the past and start living in the present.
 
7.   If person too tey for party e go follow dem wash plate
      loose translation: Don't outstay your welcome
 
8.   Craze no hard to form, na the trekking be wahala
      loose translation: Easier said than done
 
9.  No matter how hot your tempa be, e no fit boil beans.
      loose translation: Calm down,your temper won't solve the problem
 
10. Every mallam with em own kettle, every Northerner with em own radio.
      loose translation: Every man for himself 

11. Opolo eye no be open eye
      loose translation: Having Big eyes doesn't make you civilized
 
12.  Bring suya, bring suya,.......na cow body dey suffer am.
       loose translation: Every action has a consequence
 
13.   E go better e go better,na im make ibo man still dey Kano.
       loose translation: When there is hope,there is Life.
 
14.  The different between kpekere and plantain chips na packaging
       loose translation: Don't judge based on appearance alone
 
15.  Escort me, Escort me, naim slave trade take start.
      loose translation: serious things sometimes start like joke
 
16.  Pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.
       loose translation: slow and steady wins the race
 
17.  The water wey dem use take make eba can never be recovered back.
        loose translation: Don't cry over spilt milk.
Enjoy

No comments:

Post a Comment